Di qualifiers for di 2025 Afcon for Group F go go down to di final game to find who go join leaders Angola for Morocco.
Dis na afta Sudan wey dey second for di table, lose 0-4 to Niger on Thursday.
Wit dis latest result, di blackstars of Ghana wey dey fourth wit only 2 points get to win dia last two games to stand a chance to qualify.
If dem beat Angola on Friday, dem get to also beat Niger on Monday and hope say Sudan go lose dia last game against Angola.
If tins go dis way, Ghana go join Angola to qualify wit 8 points wia Sudan go finish third wit 7 points.
But if Sudan get draw for dia last game sef, dem go qualify wit 8 points wit better head-to-head record against Ghana as dem beat Ghana for Libya wia dem draw for di return leg for Accra.
Di stakes don dey high, wia Ghana dey under pressure sake of if dem no qualify for dis tournament, e go be di first time in 20 years wey dem no qualify for Afcon.
Coach Otto Addo sabi wetin dey at stake, as im tok say “mathematically we still get chance to qualify”.
Ghana Team news
Di former dortmund player scout already dey sweat as eight key players of di team don withdraw at di last minute sake of injury and oda personal reasons.
Di players wey include Bournemouth striker Antoine Semenyo, Athlitic Bilbao forward Inaki Williams and Brighton defender Tariq Lamptey all tok say dem get injury.
Di odas like Jerome Opoku from Instabul Basaksehir and Alexander Djiku wey dey play for Fernabache also bin get injury.
But LA Galaxy forward Joseph Painstil tok say im get “personal reasons” why im no fit to play for di Blackstars.
Also di coach don drop Arsenal midfielder Thomas Partey from di squad even though im tok say e wan play di games.
For one press conference on Thursday Otto Addo tok say, “to play for di national team, you get to be disciplined, you get to be a role model wey you get to show performance.”
Di coach explain say if im see say players no dey show dis qualities, im dey tok to dem to improve but if dem no change, im get di right to drop dem.
“For me, na honour to play for di national team, no be about myself and I expect di same commitment from all di players.”
Otto Addo neva tok di exact reason why im decide to drop Partey but im tok say “I don explain to am why I no call am even though di midfielder tell me say im dey available to play.”
Na so im invite oda players like Kingsley Schindler, Terry Yegbe, Francis Abu, Ransford Yeboah, Ibrahim Sulemana, Nathaniel Adjei and Michael Baidoo to replace di players wey withdraw.
Auxerre defender Gideon Mensah say even though plenty key players get injury, di team go do dia best to get di six points.
“Every player for di national team dey crucial – players dey wey we always wan see dem for di team and we also get players wey dey to support when di oda players no dey.”
Im tok say “na big loss to us say many of dis players no dey but we still get team wey go cover up, I no dey fear.”
About whether di players go dey watch di oda group F games to see if dem still get chance to qualify, Gideon explain say “we go keep our eye on top those games, but we get to do our own job by winning di six points.
“Di journey no dey easy but we get to do our part and hope everitin for di side go dey our favour,” im tell journalists.
Angola Team news
For Angola coach Pedro Goncalves, “Ghana chances to qualify dey low”.
“Ghana na one of di best kontris for Africa football wit ogbonge players for midfield and attack, but dia chances almost dey impossible,” im tok Ghanasportspage.
Di Palancas Negras get perfect points – 12 from four games, wia dem already qualify for di 2025 Afcon but dia coach say “we go play good football wit ogbonge players inside fine atmosphere and fine pitch.”
“We go do our best to beat Ghana.”
Top striker Cristovao Mabululu no go play dis match vs Ghana as im get knock, according to di Angola football federation.
Di coach don call Lens forward M’bala Nzola wey dey return to di team for di first time since March 2023 and dem call Joao Baxti wey no play for Angola since 2022.
Ogbonge player Gelson Dala wey dey play for Al-Wakrah togeda wit Boluspor defensive midfielder Estrela also go miss di game sake of injury.
Players to watch
For di black stars, di fans go dey hope say star boy Mohammed Kudus go shine for dis game as im no play well for di last three qualifiers.
Di coach also go dey count on team captain, Jordan Ayew to inspire di team togeda wit im Leicester City teammate Fatawu Issahaku.
For Angola, dia captain Fredy Kulembe go control tins from di midfield.
Di Palancas Negras go hope say di Eyupspor player go find im passing range for dis game against Ghana even though dem already qualify.
Striker Felicio Milson score late winner v Ghana for di first leg, Angola go dey count on di Red Star Belgrade forward to score di goals for dis game.
Head-to-head
Ghana and Angola don face each oda nine times.
Di Blackstars don win four wia dem draw three wit two defeat for those games.
Di last defeat for di Blackstars against Angola be di first leg of di qualifier for di Baba Yara sports stadium for Kumasi.
Dat game end 0-1 wit last minute goal for Angola
Bifor di 5 September defeat, di last time Ghana bin lose to di Palancas Negras na di 1997 Afcon qualifier for Luanda.
For di 2023 Afcon qualifiers, Ghana beat Angola 1-0 wit Antoine Semenyo im goal wia dey play 1-1 for Luanda.
Di Palancas Negras dey aim for dis 10th Afcon appearance afta dem reach di quarter finals of di last edition bifor dem lose to Nigeria.
Probable lineups
Ghana XI: Ati-Zigi (GK), Alidu Seidu, Razak Simpson, Terry Yegbe, Gideon Mensah, Elisha Owusu, Ibrahim Sulemana, Ernest Nuamah, Fatawu Issahaku, Mohammed Kudus, Jordan Ayew (c)
Angola XI: Cruz (GK), Lourenco, Fortuna, Carmo, Gaspar, Fredy (c), Ribeiro, Cafumana, Ntekja, Milson, Nzola
Dis game go happun at 8PM WAT and 7PM GMT. We go bring una live commentary.